Thursday, 16 July 2015

Ten Types of Students in a Typical UNILAG Class.

Whenever u enta  a classroom in the prestigious UNILAG, u will see students with different backgrounds and behaviors. I just want to share the 10 types of students i av noticed during this mai two years in the school.
1. The Front liners.
Na diz ones dy dy front. Dem dy listen  to wetin lecturer  dy yarn,  dm dy follow am go wherever hn dy cawie  d class go.
2. The Late Comers.
D ones wey dey here dy alwaes com class late. Na sneak dm dy alwaes  sneak enta  class. U sef go dy wonda y dem dy sneak (shae dm no b student nih).
3. The English Correctors.
Dis ones b specialists for grammar  ooo. Dem fit no dy listen for class, but make one person or Lecturer jes make one mistake lyk dis, dia work dn start.
4. Biro Borrowers.
Na biro diz ones dy alwaes borrow for class. Dem no dy eva get biro. All tru d week, na so so borrow borrow. U sef go dy ask wedda dm dn plan to wryt at all sef.
5. The Questionnaires.
Na dis ones dy make mai class dy interesting pass. Dm fit ask question for Africa make Africa vex. U go hear smthn  lyk dis ‘Sir, u sed 2 tyms 2 is 4, does dat mean the square root  of 4 is 2???’ (lyk seriously)
6. The argument Leaders.
These ones dy alwaes luk for conversations nd arguments  cos dem sabi am wella. Dem fit no knw book ooo, but u knw fit win dem for any argument. Na dia talent  b dat (God is powerful).
7. The Photocopy Crew.
Dz ones no knw pass to dy Photocopy pple note. Dm no go wryt for klass cos sae d lecturer fast pass dia hand. E sure sae UNILAG  go giv dm certificate for Photocopy wen dm wan graduate.
8. The No Timers.
U see dz ones,  na dm dy first komot for klass. If e dy possible, dm go first lecturer  komot sef cos  dm get whr dem dy alwaes rush go afta klass. (abeg shae na  persin force dm come klass???)
9. The Fashionistas.
Omo, na d big boys and gals dy here. Dem dy alwaes com klass lyk sae na fashion show dem dy go. Y lecturer no go ask sae make dem com office wen dem dy show all dia features for every klass.
10. The Noise Makers.
These ones dy different frm d argument leaders  ooo. Dem no get any topic  to discuss,  na to dy disturb and distract pple b dia job for klass. Na mai group b dz nd am kinda proud  of it. [i even dy pass paper around for klass if i no fit tlk.]
I knw  sae u sabi other groups,  feel free to add urs in d comment box.
Join our BBM CHANNEL: C00473A61  Thanks.
source : fssgist.wordpress.com
Ogbeni Deetee
5583EB8D.

No comments: